Breaking News

Jokes: If Nigerian Animals Were On Facebook: Must Read@ Kate Audu's Blog.....

If Nigerian animals were on Facebook

If animals and insects were on Facebook, we'll be having posts and comments like:
1. MOSQUITO'S WALL POST: Finally PHCN don off light, blood sucking things.
COMMENTS:
a. Shyiet, dem don on gen for my end.
b. Abeg bros which area you dey? My people don fleet house.

2. DOG'S WALL POST: Na wa oh, I never even stay reach 5mins, all these Calabar people don dey eye me. *Ghost mode
activated, them no go see me* escaping things on my mind.
COMMENTS:
My neighbour na calabar too. The man eyes no good for where dogs dey, I go soon bite am.
Lol, guy, you dey on your own oh.

3. RAT'S WALL POST: Omo na die I dey oh. No food for my master kitchen. Na ehm books go hear am nah. Ehn think say I come dis house to watch tv abi?
COMMENTS:
Your master stingy, disown am jor.
Guy, if I be you, na dat wicked master certificates I go chop sef.

4. CHICKEN'S WALL POST: On the 1st of December, I'll be traveling for one month, if you need my attention, abeg just enter bush, I no fit shout. All these Christmas celebrants no be am at all.
COMMENTS:
No be only you oh, I dey migrate too.
My brother, your head dey dia, call me wen you dey go.

5. HE-GOAT'S WALL POST: Heat mood activated, any she-goat online for s3 x chat?
COMMENTS:
She-goat. @He-goat you're a capital BIG fool.
He-goat. @She-goat, pretender does the worst, carry your smelling sef comot for my post jor.

Agree or disagree?
Drop ur comments below.

Keep visiting Kate Audu's Blog for more jokes and other related updates...

2 comments:

Drop your comments below